Erigga – Welcome to Warri Lyrics
“Welcome to Warri Lyrics by Erigga”
Yes
I Dey Always They Tell People Say For
This Town We Get 3 Different Community
Ekpa, Agbasa, & Okere
(Agbasa) If Dem Hold You Say U Thief Phone
U Dey Pay 4 Suplizer Of Phone
(Okere) If them Hold U Till Day Break Na Botto Sef U dey Sleep But
(Ekpa) If Dem Wan Give U Post Dem No Dey Look Say U Be
Indigene Na The Kind Mark Wey Dey
Ur Body Dem Take Dey Give U Position
If U Get 1 Eye U Be Vice
If Ur Hand Dey Seaze U Be P.R.O
If U Get Bullet Mark U Be D.C
If U Waka Dey Wave U Be Press
(area I hail oooooo) Old Warri
(VERSE 1)
Welcome To warri Where All The Mama’s dey Vex
F*ck Up No Dey Sawa sh!t
Her Two Hands 4 Her Breasts
Her Son Dey Press
Two Kala Under Her Dress
She Ready Shoot Olopa If Them Come Her Address (Rest)
No Be Today She Don Dey See Her Rest
Area Mama 4 D Hood U No Wan See Her Vex
Apart From Cocaine Nothing Mama No Dey Sell
1999 Dem Lock Mama Throw Her Inside Cell
Dem Carry Her Pa$$ Me Where I For Dey Play Monkey Pose
They Almost Blast Me With Slap
I Take Off With My Kittos
The First Time I See where Dem Stab Person Neck
Na 94 Two Seconds Naso Andrew Fall
Andrew Mama Dey Bust Cry
Who Do Am Don Run
Full Compound Dey Pack Ekpe The Police Dey Come
U Suppose Know Ekpe
Dat Guy Matter Na Death
Him Fit Arrest The Full Area If ee Enter Him Head
(CHORUS)
I No Be Mumu Aje
I know The Area Well
Full Agbasa, Igbodu Dem Know My Matter There
Odumu, Isoko, Ejegba We Get House 4 Ekpa
Go Oddu, Oruworu
I No Be Mumu Aje
I Know The Area well
Warri Crisis 99 I Dey There
()
We Get House 4 Ekpa
Go Ogborikpoko
()
(VERSE 2)
Dem Butcher My Friend Hand 4 Agbasa Feast
With Old Cutla$$ Naso Fight Take Enter Street
Igbo Market Men Dey Run Enter People Shop
Carry 2 Wrong Set Of Shoes Till the Feast Stop
Police Dey Shout If U Move
I No Fit Stop
Follow Me Enter Ejegba I Enter U top
Our Biggest Fright Na Ekpa Hulux Light For Night
Those Men No Get Joy Beating Na Thire Appetite
I Dey Ceiling When Dem Carry All My Guys Go
Government Bangle For The Hand Let D Dice Roll
Papa Dey Waka Police Matter 3 Weeks Straight
Native Doctor & Pastor For Here Dey Leak Plate
Imagine Say The Full Area No Get Big Man
Wetin Concern Symbol And Who Dey Sell Weed Man
Dry Bread and Sadine Plus Igbe Fanta
Na in We Dey Chop After We Don Smoke For Downtown
(CHORUS)
I No Be Mumu Aje
I No The Area Well
Full Agbasa, Igbudu, Dem Know My Matter There
Odumu, Isoko, Ejegba We Get House 4 Ekpa
Go Oddu, Oruworu
I No Be Mumu Aje
I Know The Area Well
Warri Crisis 99 I Dey There
()
We Get House 4 Ekpa
Go Ogborikpoko Ask Na
(Outro)
Yes Naso Eee Be For The Same Warri Where We Dey Area & Characters
Iyara (NairaBet)
Ido (Vigilante)
Obire (D.J)
Ereku (Dustbin)
Ogedegbo (Waka well)
Wetsu (Confra Boys)
V.T Avenue (Beggi Beggi)
Hausa Quarters (Olosho)
Karas ()
Oppe (Gamblers)
Ometa (No Neighbor)
Agbasa (No Company)
Ogono (No Market)
Makegba (Gbo Gbo)
Okere (Juju)
Ajamoga Link Road
M.P.H (Diesel)
Ogboange (Judge Judge)
Avenue Depot
Airport Road (Kpole)
Ekpa (Murder)
(Abeg)
Day Break Everywhere Bust Men
Is The Erigma 2
I Know U Waited 7 Years 4 Dis men
Guess What U No Wait In Vein Aswear
Burst Una Screen Guard
(No Limit)
All The Jam Dey Bang
Abeg Commot Ur Leg 4 High Tension